24 November 2023
One South Korea court don sentence one true crime fan to life imprisonment afta she confess to police say she kill one stranger “out of curiosity”.
Police tok say 23-year-old Jung Yoo-jung bin dey obsessed wit crime shows and novels and she get high score on psychopath tests.
She bin dey hooked wit di idea of "trying out murder", she bin use one app to meet one English-language teacher, and stab her to death for her house for May.
Di brutal killing shock South Korea.
Prosecutors bin ask for di death penalty - dealth penalty na one request dem dey reserve for di gravest of offences.
Dem tell di court say Jung wey be unemployed loner dey live wit her grandfather. Dem tok say she bin look for victims for months, wit di use of one online tutoring app to find target.
She bin contact more dan 50 pipo, mostly women, she ask if dem go like do home lessons.
For May, she pose as di mother of one high school student wey need English lessons, she contact di 26-year-old victim, wey dey live for south-eastern city of Busan.
Police neva reveal her identity.
Jung stab di teacher for more dan 100 times
Jung bin show for di teacher house and she wear school uniform wey she buy online, prosecutors tok.
Afta di teacher open door for her to enta, she attack di woman, and stab her more dan 100 times - she continue dey attack di victim even afta she don die.
She come cut-cut di woman body into many parts, take taxi and dump some of di remains for one remote parkland near one river, north of Busan.
Dem arrest her afta di taxi driver give police information about one customer wey dump one blood-soaked suitcase for bush.
Police tok say Jung online browsing history show say she bin do research for months on how to kill, and how to get rid of a body.
But she bin also dey careless, police tok, and she no try avoid CCTV cameras, wey capture as she enta and comot di tutor house several times.
On Friday, one sentencing judge for di Busan District Court tok say di killing bin "spread fear for society as pesin fit become victim for no reason" and e "incite general distrust" among di community.
Jung, wey confess to di crime for June, bin beg for easy sentence, she tok say she bin suffer from hallucinations plus oda mental disorders at di time.
ncG1vNJzZmivp6x7o67CZ5qopV%2BltqWzyKdmmqqknrCtsdJomrBoYq2%2Fu8PNoHCo